NepalIsrael.com auto goggle feed

Wia dis foto come from, Per-Anders Pettersson/Getty Images and Leon Neal/Getty Images
South Africa President Cyril Ramaphosa don call on di govment of Israel to release South Africans and oda nationals wey dem gbab as part of Israeli authorities interception of di Global Sumud Flotilla.
One statement ontop di official handle of di South African Presidency on Thursday 2 October, say di interception for international waters off di coast of Gaza “reinforce Israel continued violation of international law and infliction of suffering, including starvation, on di Palestinian pipo”.
Di flotilla comprise humanitarian vessels wey bin wan deliver aid to Gaza.
President Ramaphosa say South Africans wey bin dey inside di flotilla include Nkosi Zwelivelile Mandela wey be Nelson Mandela grandson; Zukiswa Wanner and Reaaz Moolla.
E say confirmation dey pend on di “abduction of Zaheera Soomar, Fatima Hendricks and Carrie Shelver”.
Na hundreds of activists, including Swedish climate campaigner Greta Thunberg, Israel forces detain.
“Di interception of di Global Sumud Flotilla na anoda grave offence by Israel of global solidarity and sentiment wey aim to relieve suffering for Gaza and advancing peace for di region.
“On behalf of our govment and nation, I call on Israel to immediately release di South Africans wey dey abducted in international waters, and to release oda nationals wey don try to reach Gaza wit humanitarian aid,” di statement tok.
According to President Ramaphosa, di interception of di flotilla for international waters dey contrary to international law and e violate di sovereignty of evri nation wey dia flag dey flown on di dozens of vessels for di flotilla.
“Dis action also violate one International Court of Justice injunction say humanitarian aid gatz dey allowed to flow unimpeded,” President Ramaphosa tok.
E say Israel gatz ensure say di life-saving cargo wey dey transported by dis flotilla reach di pipo of Gaza, as di flotilla represent solidarity wit Gaza, and no be confrontation wit Israel.
“South Africa support di call by di United Nations High Commissioner for Human Rights for Israel to urgently lift di blockade on Gaza and allow di entry of life-saving material through all means possible.
“My thoughts dey wit all of di abductees and dia families and na my expectation be say Israel go release di human rights activists as dis abductions no serve any purpose in di context of efforts to secure peace for di Middle East,” di President add.
Meanwhile, for June 2025, similar situation bin happun wia Israeli authorities bin seize boats wey dey try carry humanitarian aid go di Gaza Strip.
Wetin Israel tok
Meanwhile, Israel Foreign Ministry say dose wey dey involved for di Global Sumud Flotilla (GSF) don dey transferred to Israeli port so dem go deport dem.
Dem stop di first boats for 70 nautical miles off di Gaza coast for international waters and odas wey dey closer.
Na Israel dey police dis area but dem no get jurisdiction for dia.
Israel say dia navy tell di boats to change course as dem dey “approach active combat zone and dey violate lawful naval blockade”.
Na about 443 pipo dem detain from di boats and allegation dey say dem assault many of dem wit water cannon.
Although, Israel say all dose wey dem detain dey “safe and in good health”.
Israel claim say dem dey attempt to stop dose supplies make e no fall into di hands of Hamas.
Dem back anoda alternative food distribution system wit US, and di Gaza Humanitarian Foundation (GHF), wey di UN brand as unethical and “inherently unsafe”.
Wetin be flotilla
Di flotilla na global fleet of boats wey set sail to Gaza as part of one international maritime initiative to deliver humanitarian aid to pipo of Gaza.
E consist of dozens of small civilian vessels wey dey carry activists, humanitarians, doctors, and oda humans.
Di flotilla comot from Spain month ago, wit more dan 40 ships and around 500 pipo dey onboard.
According to one Aljazeera report, kontris from six continents dey take part for di flotilla, including ” kontris such as Australia, Brazil, South Africa and numerous European states”.
The post”Global Sumud Flotilla latest news: Ramaphosa demand release of Nelson Mandela grandson and odas wey Israel gbab” is auto generated by Nepalisrael.com’s Auto feed for the information purpose. [/gpt3]